#NAIJA_WHICH_WAY

GEORGE O'NUEL

GRACE AMBASSADOR POET BUDDING LAWYER CEO GOLDEN FOOTWEARS SPEAKER. PHOTOGRAPER OPTIMIST A FRIEND😊

3 articles

January 22, 2019

#Naija_Which_Way

If I teh you say I never chop since yesterday ,Shea you go believe
See, wetin I wan yan you na true talk,I no dey decieve
I don taya for Naija, but still ehnn, I LOVE THIS COUNTRY.
Naso I see Poverty wae  carry Award On top my family Tree
For Naija ; we dey Hustle like elephant dey chop like ant
Na this same country some fools (wae I no blame) dey scavenge for pant
Shea Naija dey forward ni abi  e dey retrogress 
I swear down, #10Years Challenge for Naja, We sti Never progress 
Our Leaders don build wall of China as full stop for middle of poor and rich
The system go sti try bring you down,If you try cross da bridge
House of this, National dat,Yen yen yen , Abegg wish work dem dey do sef
"Da thing" wae happen for Ghana da day na wetn most of dem deserve
Helloooo....No be me talk am o!!!!
Na from popular demand me ah hear r'am o!!!
Every sitting and meeting wea dem get,na to si down share our money
Waliah, this people no try, dem dey do us cunny cunny

Popsi don go fyn work since morning , ehin no chop before he go
Food no dey, light poor, road bad...we no get ego
Popsi don come back now, he go empty...he come empty.
Chai! Kon see as him shoe chop dust, him cloth don dirty!!!!!
Mumsy sef don lose her job for government office 
Everyday na water for her eyes and her facial surface

Na only popsi shoe dey enjoy, e don chop for under
I dey vex ryai now e be like say make I order for thunder.
Naija which way na!?....Abeg which way
Shea Na God we go pray to...abi na to go India to the "witch way


People are dying of depression 
Poverty; Our greatest infection 
My mother now has high blood pressure 
This Nonsense has met my displeasure
ASUU is giving me too much leisure 
Pain is giving Us too much lecture 
The only Time we're loved is before election 
Internet Fraud are most youth passion
Young ones are straying ;No one to caution 
 The change we were promised is Nothing but deception
 The status Quo is in recession
 Corruption has become an addiction 
 But we were not like this from the inception 
 Our Hope is fading like into a delusion
   WE'RE LOSING THIS PATRIOTIC SENSATION .

Abeggg..Make una no vex for the transmission of Gramma wae I dey spark
My anger don rish em limit I kon dey spark 
Wait sef!..wetin me sef sabi
Dem don call us "Lazy Nigeria Youth" now ,abi??
But NIGERIANS , I HAIL OH, as in, UNA DEY TRY!!!!
Make una just stay strong, make una no cry !
Today dark, bur tomorrow go bright 
Make una Uphold love and Hope, make una No Fight.
I suppose yan una plenty..but I gas go now
The garri wae I soak-travel don swell rish, make I go chop now
Make I run before dem shoot me gun for head
Truth bitter.Dem go soon throw me stone, abeg make I bend.

Maybe Sha we go dey talk later 
GOD BLESS NIGERIA AND MAKE THIS COUNTRY BETTER

I AM  "the GEORGE OLUWASANMI EMMANUEL", a concerned Citizen 
But from my Heart, I write to you as a depressed " Sick-tizen"
  
#GOD_BLESS_NIGERIA 
#GOD_BLESS_YOU 
   & 
#GOD_HELP_OUR_LEADERS
                                 
 'the George O'Nuel®
    GraceInkConcept {GIC}
        2019©

Report this

Published by

GEORGE O'NUEL

GRACE AMBASSADOR POET BUDDING LAWYER CEO GOLDEN FOOTWEARS SPEAKER. PHOTOGRAPER OPTIMIST A FRIEND😊

3 articles

January 22, 2019


Like

Reactions

No reactions yet